Police Don Dig Out Body of Woman Wey Papa K!ll for Lagos

Ebenservices
1 Min Read

Police Don Dig Out Body of Woman Wey Papa K!ll for Lagos

Police Don Dig Out Body of Woman Wey Papa K!ll for Lagos

Lagos State Police Command don arrest one man wey dem dey call Kamoru Ojo, as e dey suspected say e k!ll im 27-year-old daughter, Shakirat Ojo, come bury am for shallow grave inside dia house for Afromedia area, Ojo, Lagos.

According to police tori, the matter happen on March 26, but dem no report am reach Okokomaiko Police Station until April 3, 2025, around 8:00am, after dem receive distress call, na wetin security analyst Zagazola Makama talk be that.

Dem talk say di papa beat im daughter to d3ath for No. 31 Oshinlemo Street, Afromedia, come bury di body for dia compound.

After dem report di matter, homicide and crime scene detectives rush go di place.

Dem check everywhere well, document di scene, dig out di body, carry am go public mortuary for autopsy.

Di suspect dey under police custody now as investigation still dey go on to know wetin really happen.

Share This Article
Leave a Comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *